Monday, September 16, 2024

Foreign jobs in Canada: Canada introduce policy wey go reduce number of temporary foreign workers – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Canada dey reduce di number of temporary foreign workers wey dem go allow to enta di kontri by tens of thousands.

Canada dey do u-turn on some of dia programme wey bin do for 2022 as di goment dey struggle to bring down di numbers of temporary residents.

Di temporary foreign worker programme dey allow pipo wey no be Canadians to enta di kontri, work on a short-term basis.

Di purpose bin dey designed to fill labour shortages, and e don grow dramatically.

But e don come under fire as pipo dey accuse di programme of suppressing wages and leaving workers vulnerable to abuse, becos di work permits tie workers to employers.

One UN special rapporteur bin call am “breeding ground for modern day forms of slavery.”

Dis reduction fit no end wit affecting temporary workers, as Prime Minister Justin Trudeau bin tok say im cabinet dey also consider weda to reduce permanent resident streams.

Trudeau don dey face plenty accuse from Canadians wey dey complain say Canada dey bring too many immigrants enta di kontri.

“We dey look at di different streams to make sure say as wey dey move forward, Canada go remain place wey dey positive for dia support for immigration.

“But also responsible in di way way wey take integrate and make sure say pathways to success dey for everyone wey come to Canada,” Trudeau tell tori pipo on Monday.

Im come add say goment go present more broader plan on immigration levels dis fall.

Di changes wey di goment announce on Monday go end low-wage temporary foreign workers for communities wey dia unemployment dey 6% or higher.

E go reduce di share of employers’ workforces wey fit be low-wage temporary foreign workers to 10% plus reduce how long low-wage temporary foreign worker permit fit last to one year from two.

Internal students fro Canada hold di kontri flag

Wia dis foto come from, Getty Images

Dis changes sha no go affect some certain sectors including agriculture, food processing, construction and healthcare.

Di changes na “great first step, but na only di first step” economist and Smart Prosperity Institute senior director Mike Moffatt, wey bin call say make dem abolish low-wage stream.

If you combine dis latest announcement wit some of di changes wey di authorities don made early dis year, di expectation be say e go reduce di number of temporary foreign workers by about 65,000, Employment Minister Randy Boissonnault tell tori pipo Monday.

For April, Canada goment bin announce say beginning for September 2024, International students for di kontri work for 24 hours off campus per week.

Dat same month, di goment end di temporary policy wey allow di international students to work more dan 20 hours off campus.

During Covid-19, dem bin temporarily lift di 20 hour cap on work hours for international students to fit work.

Latest article